M.I my head my belle

Wählen Sie Sprache aus, um diese Lyrik zu übersetzen

My Belle My Head
My belle o.
My head o.
Mommy no cry. Ima go make sure
say you no die.
Ima go hustle and go try
Hunger man for neck, shey
na bowtie?
Whatever it takes, me I no shy
If na heaven food dey make we go
E better than make I sit down make
I no try
I go even buy ticket make we go
Mama. Yeah
E dey mean say, make I turn slave
kunta kinta
Anything just to make clean pay
You never see food chop since
Wednesday
Make I wash car sell and I shine
Shey na work anything, I no mind
I go do better work, even times
Coz it's not easy, It's not easy,
It's not easy.
Charley, no vex
Anything for your boys make
we go flex
No work make we do so no checks
Ha, we sef wan rock rolex
Do something for your boys, we
are loyal
You be king, you be chief, you
be royal
Alaye, you go scatter them total
International star, no be local
Hey, Ha
If we get work wey go bring better
food make we dey chop
No be road we for stand, we for
dey shop
If for say things connect like
good network
We for pay school fees, we for
dey class
You sef know say Warri no dey carry
But as things dey now we no fit
chop grass
At all, at all, na him bad pass
Naija people just surviving
Okada riding, police bribing
Pastor preaching, pay your tithing
School fees paying, food providing
Impure water, no electric
No more traffic, see the light
is sexy
Students begin the revolution
Writer everywhere, no solution
No big pothole, people dying
All the past politicians lying
University, degree pursing
Viewers thirsty, people queuing
Black market, petroleum duty
Arm-robbery, there's no security
People uprising, Niger Delta
Fuel scarcity, there's no shelter
Hey, Hey oga stop there
Abi you never see road block here?
Na we be the police, search and
stop here
If you wan pass son, gotta drop
You no dey see gun, abi you no well
If you form actor, you go go cell
See behind counter no be hotel
You go do 3 night before you go
Ha, ha
But if you wan move, you sef know
wetin you suppose do
Do am quick quick make I no expose
Biyem something make I hold true
Ess I dey call Lins make he come
Search am quick, search him bag
and him pocket
Any exhibit wey we come get
Then alarm go blow all na trumpet

KORREKTUREN ÃœBERMITTELN