Sound Sultan mothaland

Wählen Sie Sprache aus, um diese Lyrik zu übersetzen

ajo o dabile ee
no matter where u go, make u try come back area o
area o
na naija aa ah aa
ti ode ba ti le pada wale o
wale o oo uh o
how i wish... say... i fit reach u anywhere u de e
u de... eee
far away. ee e...
that one no say make u de bone area o
Motherland e oo (na your area)
Chinedu somebody borrow u ego
make u take carry go Chicago
remember nnamdi sell him car
so u go go America
all these People wey been de raise u
still de stay for face me i face u
u promise say u no go fashi them
every other month u go de tachi them
Hillary wey u been promise to marry
still de wait, o' boy she don tarry
when she go see u, na inside ovation
u marry oyinbo from another nation.
use mago mago, get dough
now your oyinbo wife don know
next thing u know, she don go report u
Wetin u know, them don deport u
how i wish... say... i fit reach u anywhere u de e
u de... eee
far away. ee e...
that one no say make u de bone area o
Motherland e oo (na your area)
ajo o dabile ee
no matter where u go, make u try come back area o
area o o
na naija aa ah aa
ti ode ba ti le pada wale o
wale o oo uh o
u been say na 1 year
e come turn to 2 years
e don go for seven years
but u de serve eleven years
even when your papa die
plus the tears your mama cry
Bayo for Chicago, them de miss u for okoko o
Biodun for Canada
your mama still de wonder
igba wo lo tơ ma pada o
remember for naija, u get iyawo
ko da bi ile, ko da bi ile, ko da bi ile e, ko da bi ile, ko da bi ile e, ko da bi ile e, ajo o ma da bi ile e
how i wish... say... i fit reach u anywhere u de e
u de... eee
far away. ee e...
that one no say make u de bone area o
Motherland e oo (na your area)
ajo o dabile ee
no matter where u go, make u try come back area o
area o o
na naija aa ah aa
ti ode ba ti le pada wale o
wale o oo uh o
u say u go call e o
every body wait tire for your call
ote o, why u go like so o
from Germany... to carry coco enter yankee
but then coco burst for your be-le
rest in peace e o
fly away, i come wonder if one day u fit to come e o
your papa land, i understand say u de so far away
u gone a long long way from home, long long way from home, long long way from home, long long way e ei

KORREKTUREN ÃœBERMITTELN