Erigga feat. Victor AD motivation

Select language to translate this lyric

It' s Victor AD na na na
King paper (kulboy)
Pikin when Dey find party rice,
nor suppose to fear dance eh (fear dance eh)
And as I come with my red eye red make
them give me chance eh (give me chance eh)
You when nor know The way song take start
, you Dey hurry to dance eh (to dance eh)
How e do you now as you dance galala inside azonto.
My biggest motivation, na those men when elbow me lost eh
OMOR My biggest motivation, na those days i nor see food chop eh
I say My biggest motivation, na those when say hustle nor go pay oh
My biggest motivation,
na those when Dey hate, 2 seconds them dey motivate us.
See, If e want burst, na 2 seconds 3 too tey
Day break everywhere burst, my woman pay
This year we go give wahala problem
Where the girls Dey, use my Benz dey go toll them
Incase them want dey assume,
na to spray the money anyhow like another man perfume
If Sazs want jump, I naked follow them.
Wetin dey happen officer, me and you get problem?
Old Warri,
me no bother nobody– so nor Dey bother me, hold this funds take press
Everywhere hard, I know e nor easy bros.
Even for hell fire now, devil sit down Dey press
Respect who get, but fear who never collect .
Him first taking, na there area take scatter.
Street na general market you fit pick too.
Suspension na hold on, rough character.
My biggest motivation, na those men when elbow me lost eh
OMOR My biggest motivation, na those days i nor see food chop eh
I say My biggest motivation, na those when say hustle nor go pay oh
My biggest motivation,
na those when Dey hate, 2 seconds them dey motivate us.
See, I dey lagos, them want turn the boy to house boy
But oluwa nor gree, him too love the boy
No joy, my guy my guy nor Dey the street
If trust dey, then water for nor fit Dey cook fish
Idle mind dey opposite devil workshop
I nor fit be apprentice, I get work to chop
I nor Dey proud about am, but wetin man go do
Pikin dey one side, Abi him nor go chop go school
If mouth want tear, my brother make e tear finish
The worst thing to happen to man, na see finish
When I die, write say I try for my grave
Life na market, and everybody here come trade
Omor the rubbish when be say my eye done
see, even this water when I cry nor fit commot am
I nor fit complain, e join wetin give me voltage
Tommorow get belle, witch nor fit abort am (lai- lai)
Pikin when Dey find party rice,
nor suppose to fear dance eh (fear dance eh)
And as I come with my red eye red make
them give me chance eh (wey you discharge)
You when nor know The way song take start,
you Dey hurry to dance eh (you done go mess up now)
How e do you now as you dance galala inside azonto.
My biggest motivation, na those men when elbow me lost eh (Abeg)
OMOR My biggest motivation, na those days i nor see food chop eh
I say My biggest motivation, na those when say hustle nor go pay oh
My biggest motivation, na those when Dey hate, (them dey hate o)
2 seconds them dey motivate us. (them dey motivate o)
Omor na the street be this o (Abeg)
When landlord dey turn to tenant (2 seconds)
Form big boy, very soon you go Dey chop remnant
You nor know say life na general
market them dey give some people suspension
Suspension na okere prison,
4 years you dey wait like pension . (2 seconds)
END BEAT FREESTYLE
Motivate yourself men
Everybody with their motivation (Abeg)
Still on collecting, Confirmation na must

SUBMIT CORRECTIONS