M how long

Seleziona il linguaggio per tradurre questo testo

Chinedu dey work since morning for Alaba
Get wife, 2 pikin, one still dey for oven
E still get dream, so much to do...
Bolanle, na since 4 she commot
To go mile 12 to buy things to sell oh
Under the rain, under the sun...
Abubakar na Bureau de Change
E dey buy gold and e dey sell gold
Anything to sell, just to survive...
Mumu get trailer for road oh
E no get e break oh
Na so, dem manage am
Dem match am, put am for road oh
As e reach road, e spoil.
Trailer fail break.
E come dey roll
E come dey roll
E come dey roll
Gbosa!!!
How long e go take,
How long e go be,
Before we go learn
How to change?
How long e go take,
How long e go be,
Before we go learn
How to change?
Nigeria na wa oh
Africa na wa oh
How long e go take?
How long e go take?
How long e go take,
How long e go be,
Before we go learn
How to change?

INVIA LE CORREZIONI