STYL-PLUS iya basira

Seleziona il linguaggio per tradurre questo testo

This na one buka wey I dey like to go.
The food sweet sote e go make your mind blow
day and night iya bas how she do am I no know.
They think say na jazz, my broad no be so.
people people make una come o
Iya basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
people People make una come o
Iya basira e go kill me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.
Long throat na food go kill u
no be so,
I say na food go kill u
oga mi no be so.
Wettin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday
na so I reach there but Sunday e don high on beer
luckily for me him junior broad eye e clear,
he say make we stroll to the area,
little did I knw that I was strolling to my burial.
Right there were oshodi bus dey load
was a little buka close to the mainroad.
I laf when e pass the door,
e tell me say hin name na Iya bas for short but I bow when e order,
iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral.
I come gree say I go manage to chop am
before I realize I dey order 2nd round
3rd round, 4th round,
I never still stop
Wetting iya basira e give me chop?
people people make una come o
Iya basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
people People make una come o
Iya basira e go kill me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.
Long throat, na food go kill u, na food go kill u.
Oga mi, u think say na play when I say na the way wey I dey,(watin do am)
e no day ok
Wetting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy iya basira rice.
Even on my girlfriend birthday
when she dey wait make I take am to ocean view,
I no know when I pass the place, the only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew
Kilon kilon shele shele
me I never see this kind juju, telle telle
All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya basira na.
I sure say still I go go there go sidon,
order my first round move to 2nd round, 3rd round 4th round I no dey ever stop
wetting iya basira come give me chop?
people people make una come o
Iya basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
people People make una come o
Iya basira e go kill me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.
Officer abeggi follow me to the palce,
everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me
my moda no gree see me my paddy ah!
Iya basira e don kill me.
Officer abeggi follow me to the palce,
everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me
my moda no gree see me my paddy ah!
Iya basira e don kill me.
Oya people, people make una stop
officer e don come
Where the woman,
hin dey inside, (oga I dey come)
Woman na wetting u dey give people chop
wey dey cause all this wahala casala, oya make we talk
Oga sir true to God,
nothing wey I dey put for the food wey I dey cook,
na God dey make am good.
Na which kind talk be that,
say na God dey cook the food abi u think say I be fool no be juju u dey put,
infact I dey suspect say na ... u wash put
sote people dey queue come dey rush for your stew,
well to confirm am bring am make I chop small.
Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw.
Chaii correct this food sweet no be small
shey una no go vex if I still order for more.
Officer no worry na the food be this
Oya people, people make una go,
case dismiss.
people people make una come o
Iya basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
people People make una come o
Iya basira e go kill me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.
people people make una come o
Iya basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
people People make una come o
Iya basira e go kill me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.

INVIA LE CORREZIONI